Police Release New Evidence For Di Timeline Of Hackman And Im Wife Death

Authorities don discover new informate wey change di timeline of wen dem believe say Academy Award winning actor Gene Hackman and im wife, Betsy Arakawa, die.

Dem find di husband and wife dead for dia New Mexico home home last month and officials bin say di two bin don die for some time before neighbourhood security discover dia deadi bodi.

Initially, officials bin say dem believe say Arakawa die on 11 February and Hackman die one week later.

Now di Santa Fe County Sheriff Office say dem confam say Arakawa bin make many calls to to one health clinic on 12 February for medical treatment, wey di clinic tell BBC she bin no come to receive.

Di sheriff office say dem bin learn about di calls wen dem collect informate from her phone.

Dem say she bin make three calls dat morning to Cloudberry Health, one personalized concierge medical practice for di area. She receive di fourth call, also from di clinic.

Di sheriff office say dem no ever report official date of death for her and say initially dem bin tok say di last activity wey dem know say Arakawa do na on 11 February. Authorities say she bin exchange emails wit one massage therapist and visit one supermarket, pharmacy and pet store. Garage clicker data show say she return home around 5:15 p.m. dat day.

Dr Josiah Child, wey dey lead Cloudberry Health, tell BBC say although di clinic no ever treat Hackman or Arakawa, she bin call dem for medical advice.

“She call and describe some congestion but no mention any respiratory distress, shortness of breath, or chest pain,” im say.

Arakawa initially bin schedule appointment for 12 February but cancel am on 10 February, explaining say she bin need to take care of her husband, Dr Child say.

On di morning of 12 February, she call again asking for treatment but becos dem no get any doctor-patient relationship wit her, di clinic tell her dem need to see her in pesin.

“Dem bin do some calls back and forth to just schedule dat appointment for di afternoon, but she no show,” Dr Child explain. “Our office call back several times and no ever get any ansa.”

Dem find di husband and wife dead on 26 February.

Chief Medical Investigator Dr. Heather Jarrell say “based on di circumstances, e make sense to conclude say na [Betsy] first die.”

Di Santa Fe medical examiner determine she die from hantavirus pulmonary syndrome, one rare rodent-borne respiratory disease.

Authorities believe say Hackman die on 18 February – di date of di last time wey im pacemaker record last before a stop work. E bin show abnormal rhythm of atrial fibrillation.

Im cause of death na serious heart disease, plus advanced Alzheimer disease wey dem bin list as contributing factor.

Sabi pipo believe say Alzheimer fit bin prevent am from realising say im wife of more dan 30 years don die inside dia house wia im dey live.

If im bin know, experts tell BBC say, e possible say im bin go through various stages of confusion and grief, trying to wake her up before di disease cause am to become distracted or too overwhelmed to act – process wey possibly bin repeat imsef for days before im too die.

One necropsy report also reveal say one of dia three dogs, wey dem bin put inside cage to recover from surgery, die from starvation and dehydration.

As di investigation continue, representatives for Hackman and Arakawa estate don go court to block di release of body camera footage plus oda visual evidence from dia home wen security bin discover dia deadi bodi.

One New Mexico judge don issue temporary restraining order wey prevent dia release, and dem set hearing for March 31.

Gene Hackman and im wife Betsy Arakawa bin dey married for more dan 30 years

Source: BBC

By CUD Wontumi

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

4 × 1 =